Blame Devil for sleeping with your Sister's/Friends husband
Nothing vex me pass when i see most Wives dey complain say deir Sister or Friend dey pregnant for dem husband, Or dem catch deir husband &Sister/ Friend having Sex...
I say ehn, where e even pain me pass na how dem go just dey blame/ curse /cry untop d husband head, forgetting say dem sisters/ Friend sef dey guilty.
This na d main reason why most wives today no dey gree let any of dem sister or Friend visit dem House too much or Atall.. Even if dem go visit, na 24hrs Survelliance watch dem go give d Visit & dem go get limit wey dat Sister/ Friend go stay reach, come GO!,
because anytin fit happen in a back-turn oo..
D wife fit go market or work or Salon; & d Sister/Friend go come dey seduce d Poor Man with her Skimpy short wears! wey dey show her Figure+boobs &Ass wey d Wife own no go sexy reach am..
D husband now, being a MUNTU wey him be, fit begin skemp d Sister/ Friend, come dey lust for him mind for dem.. Na like dis e dey happen o..
So we go say na d Sister/ Friend first create d Attraction, Intention, then Set d Trap wey d Brainless Uncontrolled Husband; fit succumb enter am.. E no go be d devil's handwork wen dem dey enjoy am o, until She (D wife) catch dem, na dere dem go begin blame Devil wey just dey him own JeJe dey drag d Whole Weed wey cloud him territory.. lol!
So i wan ask both d ladies &Men here,
with d way wey dis matter don full ground &our ears,
how una go take handle d Visits of your Wife's Sisters or Lady-Friends?...
E go short or E go Long?
She go dress Modest, or Sexy as she dey around? How?


0 Comments:
Post a Comment
Subscribe to Post Comments [Atom]
<< Home